Champions League: See how Messi and Casillas break records

Iker Casillas and Lionel Messi make history for di first night of 2018/19 UEFA Champions League campaign.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Uefa Champions League resume for Tuesday night as 32 football clubs begin drag battle for di cup. Eight matches happun for Matchday one and e see clubs score plenty goals wey include Lionel Messi hat-trick.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lionel Messi score record breaking eight Champions League hat-trick to helep Barcelona nack PSV Eindhoven 4-0.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Substitute Roberto Firmino score late goal wey see Liverpool beat PSG 3-2.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kylian Mbappe bin score di equaliser for PSG to make am 2-2.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tottenham wey dey di same group wit Barcelona lose to Inter Milan for San Siro afta dem score two late goals.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mattias Vecino na im score di second goal for Inter Milan wey break Tottenham Hotspur hearts as dem lose 2-1.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Porto goalkeeper Iker Casillas make history as di only player wey don play 20 UEFA Champions League campaign.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Diego Costa and Jose Gimenez goals help Atletico Madrid overcome Monaco 2-1 for dia own group match.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, America player Christian Pulisic score 85th minute goal for Borussia Dortmund as dem sama Club Brugge 0 -1 away goal.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Eight oda matches go dey today (Wednesday) as Cristiano Ronaldo go hope to score e first Champions League goal for im new club Juventus.