Gen. Sani Abacha

Di main tori wey happun for di life of di late dictator
E don reach 20 years since Nigerian military ruler Sani Abacha die.

Na wit iron hand im bin take rule Nigeria and plenti human rights wahala full im goment.

Even till today, Abacha na pesin wey still dey cause kwanta for im kontri. President Muhammadu Buhari, wey imsef be former military ruler, don hail am for di ogbonge tins wey im do like roads wey im build, education and health.

See as di life of di late dictator take waka

  • 20 September 1943
    Di area Kano, Nigeria
    Kano, Nigeria foto
    Di informate Na for Kano State, northern Nigeria dem born General Sani Abacha.
  • 1963
    Di area
     foto
    Di informate Im finish school for di Nigerian Military Training Centre for Kaduna den do more training for UK.
  • 1965
    Di area Nigeria
    Nigeria foto
    Di informate Im marry Maryam Jiddah. Dem born 10 pikin, but one of dem come later die.
  • 1967-72
    Di area Southern Nigeria
    Southern Nigeria foto
    Di informate During civil war for Nigeria, Abacha fight for di federal side against Biafra and im continue to dey chop express promotion for army.
  • 1983
    Di area Lagos, Nigeria
    Lagos, Nigeria foto
    Di informate Im name first enta di mouth of Nigerians sake of im connect wit di 31 December coup wey comot civilian Presido, Shehu Shagari. Gen Buhari na di next pesin wey wear di cap as military ruler.
  • 1985
    Di area Lagos, Nigeria
    Lagos, Nigeria foto
    Di informate Na wit force dem comot Gen Buhari for coup wey Abacha support. Im help Gen Ibrahim Babangida takeover and dem uprade am to major general.
  • 12 June 1993
    Di area Lagos, Nigeria
    Lagos, Nigeria foto
    Di informate Dem do democratic elections wey military bin don dey promise tey tey. Early results show say na rich businessman Moshood Abiola dey win but Gen Babangida do u-turn cancel di result wey vex Nigerians.
  • August 1993
    Di area Abuja, Nigeria
    Abuja, Nigeria foto
    Di informate Abacha upgrade to Minister of Defence afta Babangida, wey resign later, make Ernest Shonekan civilian presido in charge of goment for di main time.
  • 17 November 1993
    Di area Abuja, Nigeria
    Abuja, Nigeria foto
    Di informate Shonekan resign afta im cari im power give Abacha. Sabi pipo suspect dis u-turn na anoda coup. Abacha rule boku wit human rights wahala and di way im harsh on top opposition.
  • 1994
    Di area Nigeria
    Nigeria foto
    Di informate Moshood Abiola, wey many Nigerians believe win di 12 June election, crown imsef president for Lagos and na dis land am for prison.
  • 1995
    Di area Ogoni, Nigeria
    Ogoni, Nigeria foto
    Di informate Abacha goment chop black eye afta dem condemn am all over di world and dem collect suspension from Di Commonwealth afta dem execute di Ogoni Nine, wey be activists wey dey protest di bad bad tins goment and oil big boys Shell dey do. Among di activists wey die na writer and Nobel Prize nominee Ken Saro-Wiwa.
  • 1996
    Di area West Africa
    West Africa foto
    Di informate Dem choose Abacha as chairman for di Economic Community of West African States (Ecowas), wey be economic join-body for di region.
  • February 1998
    Di area Sierra Leone
    Sierra Leone foto
    Di informate Abacha send Nigeria military go Sierra Leone wit mission to comot di military goment wey tanda for dia afta dem bin comot civilian goment one year before den.
  • 8 June 1998
    Di area Abuja, Nigeria
    Abuja, Nigeria foto
    Di informate Abacha die unto suspected heart attack and dem bury am for di same day. Nigeria begin journey go meet democracy one year later.

Di work of:

Yemisi Adegoke na im produce am

Olawale Malomo sidon on top development

Olaniyi Adebimpe na di desgin wizkid

Foto: AFP, Getty Images, Nigeria High Commission.

Share dis page