Endsars protest Lekki tollgate: Pictures of how di one year anniversary waka

Some Nigerians gada on for Lekki tollgate on Wednesday to remember wetin happun during di nationwide End Sars protest wey rock Nigeria for 2020.

Wetin we call dis foto, Police for Lagos arrest at least six pipo wey come out to protest on di anniversary of di alleged shooting for Lekki tollgate.
Wetin we call dis foto, Some of di protesters enta motor to mark one year of di nationwide EndSars protest wey rock Nigeria for 2020.
Wetin we call dis foto, One of di protesters wey police arrest during di anniversary of di Lekki tollgate protest
Wetin we call dis foto, Police bin sama warning say make no bodi comot to protest but protesters do car procession
Wetin we call dis foto, Comedian wey dey popularly known as Mr Macaroni bin announce on Monday say protest go hold despite di police warning.
Wetin we call dis foto, Pipo abandon dia cars run as police wey full ground for di Lekki toll gate, Lagos, Nigeria fire tear gas
Wetin we call dis foto, Nigeria musician Falz bin announce on Monday say protest go hold despite di police warning. E come out to lead di car procession dem use take protest
Wetin we call dis foto, Number one Area Fada for Nigeria, Charly Boy also join to mark di End Sars anniversary
Wetin we call dis foto, Police drag one young man wey dem claim say bring 'charms' and cutlass come di memorial grounds for di #EndSARS protest
Wetin we call dis foto, Police pack dem self for di Lekki tollgate afta dem give warning to protesters
Wetin we call dis foto, Di protest hold on Wednesday to remember wetin happun during di nationwide protest wey rock Nigeria for 2020.
Wetin we call dis foto, Di 2020 End Sars protest bin call for end to police brutality
Wetin we call dis foto, Some protesters wave flags inside dia cars, odas wave fliers and posters wey carry different messages
Wetin we call dis foto, Police dey drag End Sars protester for di grounds of di protest for Lekki on di anniversary day. Part of di tins wey protesters tok be say goment neva admit say dem kill pipo for di Lekki tollgate
Wetin we call dis foto, Security Personnel plenti for di Lekki tollgate wey be di venue for di End Sars protest anniversary
Wetin we call dis foto, Cars, wristwatch, caps, slippers, flags na some of di tins pipo run leave comot afta police disperse #EndSARS memorial protesters for lekki toll gate wit tear gas.
Wetin we call dis foto, Pesin wave Nigeria flag on di End Sars protest one year anniversary for Lekki Tollgate
Wetin we call dis foto, Police use tear gas take disperse #EndSARS memorial protesters for lekki tollgate
Wetin we call dis foto, Some Revolution Now pipo also join mark di anniversary
Wetin we call dis foto, Nigeria Minster of Information and Culture, Lai Mohammed tok say even afta one year, evidence no dey wey show any massacre happen for di Lekki toll gate.