Adeleke defeat Oyetola to win Osun govnorship election
Live updates from Osun state wia residents dey elect dia next govnor.
Live Coverage
Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Victor Ezeama
'Election go dey conclusive'- Inec National Commissioner
Wia dis foto come from, TVC
Inec say dem don get results of all di 30 local goment areas for di Osun state governorship election.
E say all di results dey dia portal, Inec add.
National commissioner of Inec in charge of Southwest zone, Prof Kunle Ajayi say di election officer dey on dia way to Inec office wit di hard copies of di result.
Prof. Ajayi also tok say di election no go dey inconclusive
Oga commend all di stakeholders for making di election successful.
E assure say dis year election go dey conclusive, say make pipo no fear.
Breaking, Ademola Adeleke win Gboyega Oyetola for Ifelodun
APC - 16068
PDP - 17,107
LP - 18
SDP - 12
Breaking, Ademola Adeleke win for Atakumosa west
APC - 6,601
PDP - 7,750
LP - 13
SDP - 11
Breaking, Adeleke beat Oyetola for Ila
APC - 11,163
PDP - 13,036
LP - 06
SDP - 09
Breaking, Oyetola suffer defeat for Osogbo local goment as Adeleke win
APC - 22,952
PDP - 30,401
LP - 79
SDP - 62
Breaking, APC flog PDP for Ilesha east
Candidate of di APC Gboyega Oyetola na im win for di Ilesa East LGA
APC - 13,452
PDP - 10,969
LP - 33
SDP - 32
Breaking, PDP defeat APC for Boluwaduro
Ademola Adeleke of di PDP na im for di Boluwaduro local goment area of Osun state.
APC 5469
PDP 5860
LP 09
SDP 03
We don come back!
Collation of election results go begin any moment.
We dey come back!
We go come back wen INEC dey ready to begin collation of results.
Journalists gada dey wait for Inec collation centre
As candidates and popi for Osun state dey await di outcome of di Saturday gubernatorial election, journalists don gada dey wait for di results collation centre wey dey inside INEC office for Osogbo, di state capital.
Dis na wia di returing officer go take all di results from di 30 local goments areas .
Results de expected to dey trickle in any moment local goment by local goment.
Election take place for 3,673 polling units of 332 registration areas of di state.
Over 1.4 millions naim bin collect pvcs ahead of di polls according to di INEC boss for di state, Prof. Abdulganiy Raji
See photos from di centre:
Wetin we call dis foto, Chairs wey party agent go take siddon
Photo show how man wey dey live wit albinism take vote
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Candidates, voters dey await election result
As voting don end for di Osun state govnorship election wey hold on Saturday July 16, residents including di candidates wey contest for di election dey wait eagerly for di outcome of di polls.
Dis na as oda kontri pipo dey monitor closely to see di candidate wey go emerge winner of di election.
Di election exercise happun for 3,763 polling units wey dey across 332 registration areas for di state.
Na 15 candidates wey represent 15 political parties particpate for di election.
Our repoters early tok say dem witness cases of vote buying for some parts of di state.
But, di election dey largely peaceful for most of di polling unit.
We don come back!
We welcome una back as we continue to give you updates for di Osun state govnorship election wey happun across all di 30 local goment areas of di state on July 16.
We dey go on break!
We dey go on break and go come back by 8pm to continue to give you di Osun election updates as e dey shele.
Make you scroll to read our updates on how di election don go so far.
If you want also see wen dem go announce di election result, go here: Osun election results.
Govnor Gboyega Oyetola win im polling unit
Govnor Gboyega Oyetola of di All Progressives Congress (APC) don win im polling unit for Oloti Ward 1, PU 2.
Oyetola score 545 votes while im close rival wey be di Peoples Democratic Party candidate (PDP) Ademola Adeleke score 69.
Wetin Osun govnorship candidates tok afta dem cast dia votes
Di candidate of di Peoples Democratic Party for di Osun State
govnorship election Ademola Adeleke tok afta e cast im vote say di Independent
National Electoral Commission (INEC) don improve.
"I give INEC kudos sake of say dem don improve," e
tok.
E say di turnout for di election dey very impressive.
Adeleke also tok say e jump queue to vote sake of say na di pipo
tell am say make e go vote instead of joining di queue.
Di candidate of Labour Party (LP) Yusuff Lasun also speak afta e cast im vote. E say e take am close to 10 minutes to cast im vote.
E say e neva sabi wetin dey go on for di election sake of say e neva listen to news and e neva pick calls but once e enta house, e go go watch television to follow di election.
"I don dey vote since 1979 wen I komot from secondary school.I don dey consistent for my polling unit and dis na my family compound," Lasun tok.
Di LP candidate say pipo dey come out well well for im polling unit to vote and dem do di same tin today.
E say if pipo go out today to buy vote, Nigeria dey in trouble.
PDP candidate Ademola Adeleke win im polling unit
Di candidate of di People's Democratic Party (PDP) Ademola Adeleke don win polling unit 9, ward 2, Sagba Agbogunde, Ede North Local Goment Area wia e come from.
Adeleke score 218 votes for di polling unit while Govnor Gboyega Oyetola score 23 votes.
Vote sorting and counting don start
Vote sorting and counting don start for some polling units across Osun state afta election officially end.
Check out how dem count di vote for di polling unit of di PDP governorship candidate, Ademola Adeleke for unit 9, ward 2 for Sagba Abogunde, Ede North LGA of Osun state.
Sorting plus counting of ballots don begin
Wetin we call dis foto, Sorting of votes dey happun for Osun election
Voting don close for Ward 1, unit 3 Nepa Iragbiji, Boripe local goment area of Osun state.
Voting process wey start at 8:30am officially close at 2:30pm.
Dis na di situation for most of di polling units wey dey di local goment except for some places wia plenti voters still dey on di queue and dem dey wait to vote.
INEC presiding officer for dis unit 3 don begin dey sort di ballots as party agents plus oda pipo gada dey monitor.
Na di same for ward 8, unit 3 Olorunsogo for Ikirun Ifelodun local goment area.
INEC presiding officers for di unit don begin count di ballots as voters gada to watch.
'Youths' scata ballot box for Kajola afta yawa gas between party agents and security officials
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don
record a case of vote disruption for di Osun state govnorship election.
Di incident happun for Polling unit 11, ward 7 for
Kajola, Atakumosa West Local goment area of Osun state.
Tori be say some armed men bin come arrest some pipo for
di polling unit for Atakumosa LGA of di state.
One eyewitness tell BBC Pidgin say di men wey wia uniform of one of di security agencies for Nigeria just pick up di men without explanation.
"We no know wia dem carry dem go," di eyewitness tok.
Di incident lead to argument between voters and political party agents wey later turn violent.
"Dem beat di police officer wey dey di polling unit as e dey try to resolve di mata. Na di dragging make dem break di ballot box.
"Dis na why di police officer call for reinforcement wey make di DPO come," anoda eyewitness tok.
Di Resident electoral commissioner of Inec for Osun state, Prof Abdulganiyu Raji visit Kajola to also know wetin happun.
Police DPO for Kajola and di election monitoring team brief Inec oga on wetin happun - e later ask di community pipo wetin dem want.
While some say make Inec count di votes wey dem don already cast before di disruption, odas say make dem kontinu wit di voting.
Police decide to secure di ballot box wey don break as di pipo no fit agree on wetin to do.
Director-general of the National Youth Service Corps (NYSC), Mohammed Fada, wey visit di scene, secure di safety of di youth corps members wey dey di polling unit.
Di decision of Inec on wetin happun for Kajola neva dey known.