You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

France don win World Cup

France win dia second World Cup for history, as dem nack Croatia for match wey get plenti action, including pipo wey run enta field.

Live Coverage

Busayo Iruemiobe

  1. Una bye bye, France 4-2 Croatia

    We hope say you enjoy how we take give you dis World Cup as e take happun for Russia. Di next wan na for Qatar for 2022.

  2. E don end. Les Bleus na di champions, France 4-2 Croatia

  3. INJURY TIME, France 4-2 Croatia

    Na five minutes dem put. Croatia fit get two goals to cari dis game enta extra time?

  4. 90 minutes, France 4-2 Croatia

    Na added time wey dey wait for now. But e be like dis cup dey go France.

  5. , Tension hold everibodi

  6. Seven minutes to go, France 4-2 Croatia

  7. SUBSTITUTION, France 4-2 Croatia

    France don comot Giroud put Fekir. Croatia comot Strnic put Pjaca.

  8. How you dey see di game?, France 4-2 Croatia

    We go like hear from you. Just drop your comment for here:Link

  9. , France 4-2 Croatia

    Six goals so far, VAR, penarity, goalkeeper error.

    Dis World Cup final na helele.

  10. Meanwhile, going home!!!

  11. Hugo, wetin you bin dey tink?, France 4-2 Croatia.

    Na only Hugo Lloris go fit tok why im wan dribble Mandzukic inside 18. Croatia fit score two more?

  12. GOAL, France 4-2 Croatia. Mario Mandzukic profit from Lloris mistake.

  13. GOAL, France 4-1 Croatia

    Dis match don dey turn to massacre ni.

  14. GOAL, France 3-1 Croatia. Paul Pogba na im blast am enta.

  15. SUBSTITUTION, France 2-1 Croatia

    France don comot N' Golo Kante put Steven Nzonzi.

  16. France, Africa United?, France 2-1 Croatia

  17. Second half don start, France 2-1 Croatia

  18. , Paris dey bubble.

  19. , Wawu!!

  20. For those wey dey cari eye find di Croatian presido

    Kolinda Grabar-Kitarovic don turn many fans head for dis World Cup wit her smile and how she take like football.