Why OPM General Overseer suspend di marriage of im autistic children

Wia dis foto come from, Omega Power Ministry/Facebook

Read am in 4 mins

General Overseer of Omega Power Ministry (OPM), Chibuzor Chinyere, don suspend marriage plans for im autistic adopted children.

Dis dey come afta e meet wit di Rivers State Ministry of Social Welfare and Rehabilitation as dem tok wit am about di implications of im actions.

Di General overseer bin announce plans to find a husband for im 21-year-old autistic adopted daughter shortly afta di marriage of anoda of im adopted autistic son trend for social media and e say di prospective groom gatz young, able-bodied man.

E also stress say elderly individuals or pipo wit disabilities no go dey considered.

Wia dis foto come from, Chibuzor Gift Chinyere

Wetin we call dis foto, Aboy Chibuzor wit im wife afta dia wedding

However, Apostle Chinyere tell BBC News Pidgin say e receive ova 1,000 applications from prospective suitors. E say di husband go enjoy benefits wey include lifetime stipend and a jointly owned house.

E add say di ministry go conduct periodic, unannounced visits to monitor di marriage and ensure say di woman no dey exposed to abuse or neglect.

Dis decision to find a suitable husband for Chiemeka, im adopted autistic daughter, dey come just few weeks afta e conduct di marriage of im autistic son, Aboy Chibuzor.

Aboy, wey dey non-verbal and require assistance wit daily activities, marry on 29 March and di man of God don already fulfil some of di promises wey e bin make to di woman wey marry Aboy.

Dis marriage draw plenti tok-tok as many raise concerns about di legality of di marriage among oda concerns wey make di Rivers State Ministry of Social Welfare and Rehabilitation invite am.

Why Rivers State Govment invite OPM founder?

Wia dis foto come from, FIDA Rivers State

Wetin we call dis foto, Di Rivers State Ministry of Social Welfare and Rehabilitation and Fida meet with di OPM founder over violation of child rights law from di marriage of im autistic children

Di Rivers State Govment through di ministry of social welfare and rehabilitation invite Apostle Chibuzor Chinyere to address public concerns ova child right violation wey involve one autistic child wey e give out in marriage, to ensure compliance wit state laws.

Di International Federation of Women Lawyers (Fida), Rivers State Branch, led by di Chairperson, Tamunouemi Life-George bin also dey di closed-door meeting.

Permanent Secretary of di Ministry of Social Welfare and Rehabilitation, Lauretta Davies Dimpka explain say di actions of di OPM General Overseer although e do am in good faith, bin breach existing laws.

"For example, we don give am some examples of actions e take recently on social media wey no dey in line," she tok.

Davies Dimpka cite di Child's Rights Act of 2003, di Persons with Disabilities Act as well as di Violence Against Persons Prohibition Act, as di basis for di ministry position.

Di Permanent Secretary say di OPM General Overseer do well say e honour di ministry invitation and show willingness to align wit govment regulations, and urge oda faith-based and private institutions to ensure say dia childcare activities also comply wit di law.

She emphasise say all individuals and organisations wey dey operate children homes or orphanages for di state gatz obtain proper registration and approvals from di ministry.

Apostle Chinyere also admit say im bin no know say e need to register im orphanage and get approval to house minors.

E pledge immediate compliance wit di Permanent Secretary directives and add say di meeting na eye-opener.

"Dis meeting don open my eyes becos e get some tins I bin dey do wey I no know say dey wrong.

"I dey veri happy say I now know di right tin, and I go do di right tin going forward," e tok.

Di Ministry of Social Welfare and Rehabilitation say di meeting na part of dia ongoing enforcement of di Rivers State Child Rights Law and di Violence Against Persons (Prohibition) Law, wey aim to protect vulnerable children across di state.