Supreme Court reserve judgment for appeals by ADC and PDP
Wia dis foto come from, Supreme Court/ADC/PDP/Website
Di Supreme Court don reserve judgment for mata wey involve Nigeria opposition parties, ADC and PDP.
Nigeria highest court on Wednesday start session wit di mata wey concern di People's Democratic Party (PDP).
Dis one na di one wey involve former Jigawa govnor Sule Lamido, Inec, Austin Nwachukwu and two odas as respondents.
Dem first regularise di processes and before dem hear di main appeal.
For di ADC mata, di Supreme Court hear di appeal of Senator David Mark wey dey challenge di March 12, 2026, Court of Appeal judgment wey bin dismiss im appeal.
Na Nafiu Bala Gombe wey be di former Deputy National Chairman start di mata for di Federal High Court in Abuja.
Oga Mark argue say di Appeal court cross di line of dia jurisdiction. Im also beg di Supreme Court make dem give order to maintain status quo ante bellum for di suit wey oda party members wey Nafiu-Bala Gombe dey lead, wey dey para.
Apart from Gombe, other respondents for di appeal include di ADC, the National Secretary Rauf Aregbesola, Inec, and the immediate past national chairman of the party, Chief Ralph Nwosu.
E neva clear wen di Supreme Court go deliver judgement on diz matas but as na case wey concern di 2027 general election, e no go tey.
Supreme Court on PDP
Di five-member panel of di apex court say dem go deliver dia judgment on one date wey dem go later communicate to all parties wey dey di appeal.
Justice Garba Mohammed, wey lead di five-member panel, make di announcement shortly afta lawyers wey represent parties for di appeal adopt dia processes as briefs of dia arguments for and against di appeal.
Di appeal na di Turaki-led group national executives of di party wey come out from the convention file am.
Dem go meet di apex court to challenge di judgment of the Court of Appeal, wey cancel di convention because say dem hold am in disobedience of valid court order.
As dem adopt dia brief of argument wey dem file on April 2, di appellants, through their team of lawyers wey Paul Erokoro (SAN) lead, beg the Supreme Court say make dem no just allow dia appeal, but also make dem dismiss di cross-appeal wey one leadership group for the party wey align wit di Minister of the Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, file against them.
Meanwhile, Lamido, wey Mr J. C. Njikonye (SAN) represent, togeda wit di Wike-backed group wey Joseph Daudu (SAN) represent, file preliminary objections wey dey seek make the court dismiss di appeal.
Di respondents insist say, contrary to wetin the Turaki-led group tok, di appeal no fall under PDP internal affairs.
Na di respondents position be say both di high court and di appellate court rightly exercise jurisdiction over di matter.
Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja bin, last year, for one judgment, stop di den-Ambassador Iliya Damagum-led National Executive Committee of PDP from going ahead wit di convention wey dem plan for November 15 and 16, 2026, for Ibadan, Oyo State.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available